…….I looked into my phone screen and saw seye’s name….
I picked it up and we started conversing
me: oya baddo of life kilowa
seye: bigman hwfa now?
Me: i just dey o..,hope na home you dey dis time around and not club?
seye: wich kyn qst b dat…..were you not in class for the test today ni?
me: wich test….
Seye: mathematics now
me: haaaaa.i neva hear anytin now…na house i dey jawe
seye: me self don dey house. i left school immediately we finished the test
me: goodd so me don missed a test be that right?
seye: that one no concern me, alaye na 1 rumor i dey hear 4 town o
me: wetin be dat? I neva hamer nw…wetin dem
dey talk about me?
Seye: ogbeni na story about you, seyi and the girl wey dey sell fish
me: wetin u dey hear
seye: dont tel me na true o
me: wetin na ?
Seye: i hear say u liv seyi 4 fausa?
Me: naso bro….but shey b na ur advice I followed?sey mak i find som1 i go dey bleep for outside if seyi refuse to giv me her own toto to sample
seye: you are right but i never tell you to quit the relationship now, did i?…una wan kill the girl bah?
me: kill bawo?
Seye: com see how dem dey talk am for school sey she always get mad in lecture room…dey said u will call her for like 4times before she go answer you
me: woo (see) alaye liv that 1 jare….i get gist 4 u
seye: me too get gist for you but yours first
me: no p….if u see how fausa dey satisfy me
with s*x, infact if we cover the show and sell am for public, am gona becom a X-rated superstar asap in a short time
seye: thats gud nw..shey b na wetin u want be dat..,..but count me out from the show o. no be me advise u to switch fromm seyi to fausa o…….
Me: guy let leave dat aside jare…wetin u wan gist me jur
seye: how u go take bliv me….u wey don fall in
love already
me: say wetin una wan say jur..,….shey i b romeo ni?
Seye: ok o..,.na ur wife i see now at teecrown bar and suite…with our sug gensec….
Me: lol, may be they have something fishy ni
seye: ode (fool) if u b sombi, me no b dejo..cos ah be confam omo’gboro…..shey u no go knw different between business partners and s*x partners? If u see how them do enter bar.i bet it u go faint..com see how dey cuddled themself while drinking…
Me: are you serious?
Seye: siddon there….wat shock me most was the kissing they give to each other, I never think the gurl don give you the kind before
me: bro free me now…..am having headache. Let chat on bbm later
seye: ok bro., you better think very well before too late for you., ….he hung up……..
…….this guy must be a tragic liar jur………it can’t be true lailai, how my one and only fausa will be flirting around upon every services I render to her…. What else is she looking for????? Yes can’t be true,, it might be na plan work of seye and seyi to scatter this relationship…
Related episodes
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}