Must Read: The Male Secretary (18 )

Episode 7 years ago

Must Read: The Male Secretary (18 )

Saturday morning met me cleaning my the house and preparing for what was to come that day. Na so I just dey clean and re-clean the whole place dey calculate as the Bleeping was be like. As I satisfy say house don clean well I just comot say make I go buy high-up wey I go take and other things wey the woman go like drink when she come. I reach shop buy 4 medium stout, 2 malt, 1 alomo and one packet of durex condom. I no dey risk am jor.

I reach house come enter kitchen begin prepare indomie and boiled egg wey I go chop that morning when my phone just ring. Sharp sharp na so I rush go the phone place come pick am see say na Sandra dey call me. I just dey look the phone till e stop to dey ring come put am back for my pocket waka enter inside kitchen go continue with my cooking. Na so my phone ring again, I pick:

“You did not pick the call when I called the first time”

Na the first thing wey she just tell me be that. Na so I smile:

“I was busy in the kitchen and when I came to pick the call had already cut”

I just lie give am.

“Owk, I’m at the junction where we do enter car in the morning”

Kai, so soon. Haka ne gindi yana mata a jikin ta ne (did I just write in Hausa, well sorry)? I asked myself but then I braced up and replied.
“I’m on my way, just give me ten minutes”

The line went dead on the other end while I hastily dished out the indomie, peeled the cooked egg and used it to adorn the top before shutting the door and making my way to the junction. As I came closer my phone rang, looking at it I saw “Tonia”, a girl I had promised was going to come to my house.

Previous Episode

Must Read: The Male Secretary (18 )

Next Episode

Must Read: The Male Secretary (18 )

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Madam Secretary S06E10 - Leaving the Station
episode | 4 years ago

Madam Secretary S06E10 - Leaving the Station

Madam Secretary S06E09 - CARPE DIEM
episode | 4 years ago

Madam Secretary S06E09 - CARPE DIEM

Madam Secretary S06E08 - SHIPS AND COUNTRIES
episode | 4 years ago

Madam Secretary S06E08 - SHIPS AND COUNTRIES

Madam Secretary S06E07 -Accountability
episode | 4 years ago

Madam Secretary S06E07 -Accountability