Reflections - Season 1 - Episode 69

Episode 4 years ago

Reflections - Season 1 - Episode 69

I stood in the center of everyone.. I looked at the girls who could loose their lives in seconds simply because miebi felt betrayed and I let my d--k cloud my judgement.. The last thing I wanted was for anyone to get hurt..
Me.. Make everyone calm down.. Uriel you know say ona no go fit follow us dance… So make ona no waste ona time.. Before g nut go catch pesin pikin for here oo.. Tell ur girls to relax their urge (lower weapons).. Because miebi don offend pass offend oo.. As e dey be so.. Ona weight no reach to stop our ship from sailing miebi to sea port oo..


Uriel.. Baka you know this matter oo.. No force me to fall ona for here oo.. Ona no dey Comot here with our arch oo..

Baka.. Quiet there Uriel.. E be like ona don forget who we be for this island.. I no wan fall pesin oo.. Make ona relax ona urge oo.. Uriel you know the rules.. This babe don offend full ship.. She gatz follow men sail be that..
Girl 3..taaa.. Ona dey our deck oo.. Ona no fit comot here with our arch oo.. The heavens go rain blood be that o..

Qiunto.. (shouting and gyrating).. Abeg make ona hold me oo.. G nut go catch pesin for here oo.. Ona no dey fear?..Ona dey mad?. Ona don chop winch ba?.. ona jonzin Angelina’s wan stop ship from sailing?.. Ona don baff?.. Taaa wida all of ona loose guarding compass.. Ona blood go turn the seas red if ona try to stop us oo..

Baka (facing miebi).. Oya jazz in that hilux sharperly..

Smiles… (pushing miebi against her wish).. Comon move it.. Jonzin Angelina..
Suddenly one of the girls opened fire on smiles… But unfortunately for her the bullet bounced (OKB standard).. Tilapia replied by buring 3 bullets in her right arm and her left leg (dammn tilapia Sef ehn).. The girl went crashing down shouting in pain as the whole white angels opened fire but Baka ordered us not to retaliate.. I ran for cover though because I didn’t have any jazz like my men.. All the bullets bounced on the guys.. As I saw a look of fright and concern on the faces of the Angelinas..

Baka.. Uriel you see ur life?.. Shebi if I blow ona shot now dem go say I wicked?.. See na just one thing make me no end all of ona for here.. SSO!!!

My frat guys.. Bloody!!
Uriel.. If your taken her we are coming with you..

Baka.. Taa Comon die it there Uriel.. You lost that privilege when you guys tried to kill us..
That was how we bundled miebi to the sea port oo.. When we got there the guys wanted to strip miebi and sodomize her but I had other plans so I begged them to let her be.. I even asked them to give her a bottle of spirit (if only she knew).. I was very weak and sore all over my body due to my ordeal I had been through so I sat quietly at Baka’s parlour with the guys explaining to dem all I had been through..
Tilapia. But Giddi if no be say na you.. I swear you for catch drill oo.. Wida you na..
Qiunto.. Na true oo.. We find you tire.. Franklin and biodun lap come give men official (report) say ur babe dey call them dey find you.. We come dey find you oo..

Previous Episode

Reflections - Season 1 - Episode 68

Next Episode

Reflections - Season 1 - Episode 70

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)