"Allow ads" and Popups to avoid redirection of your browsers.

Must Read: How I Take Service A

Episode 7 years ago

Must Read: How I Take Service A

” U no wan call me bak abi.. U de form big boy. No
wahala…anyway I call u mak I tell u sori 4 wetin dat
babe do u ystday…I pity 4 u sha..”
” Oh! Funke. How far ? ” I ask
” Who be funke…ok o… No wahala…continue de
mention all de babes wey u get 4 dis camp..infact
na u b de next pesin wey dem go catch, why I de
even …..”


” Anita. Hw u dey. Why I nogo delete ur numba.



Afta
wetin u do me. Abeg no jus start dis mornin. ”
she ask me wia I dey, I tell am. she say she de com.



15mins leta naim anita land our table. Na dat time I
rememba bekky. I ask biggy wia bekky dey, he say
mak I ask anita her friend, I ask anita she say mak I
ask biggy ha husband, evribodi stat de laff. She leta
tok say bekky dey ha hostel. We jus de gist de go.



She ask me as I take de prepare 4 d camp carnival
wey go hapun 2moro( thursday), I tell am say I neva
get any plan bt mak we de watch as im go be.
” I no say many guys don already book u mak una
dey 2geda as celebrity wey u be nah ” I joke giv am
She reply me say she go jus dey on her own. If she
watch d carnival tire she go enta hostel go sleep.



Biggy tell am mak she com so dat all of us go dey
2geda, she say she go tink about am.



Thursday evening 4.30pm naim de carnival tak
start. Coppas de vex say d tin start very late.



me,
biggy and bekky dey. We de watch as evribodi jus
de jolly, evribodi hapi. Different colour evriwia.



Music de play 4 d field, pple de dance. Soldiers and
coppas jus de play, Evribodi just dey 4 good mood.


Na d carnival b dis.


Anita neva call. Biggy say mak I call am but I swear
say dat 1 nogo hapun, I no even boda ask ha friend
wia she dey sef. Anywia she like mak she dey I no
send.


I still use style de observ d babes wey de pass, mak
I no weda I go see any fine one wey I go toast.



One
black slim one com de pass, I call am she com.



We de gist, she say her name na mary and she 4rm
benue state, we jus de yarn like say we don sabi
oursef tey tey, I even surprise as de babe jst relax
wit me, ha friend call am mak dem de go but she tell
am mak she de go say she go join am leta. I ask de
babe as ha paroles go be afta camp say I go like
mak me and am run things, she say no wahala, say
make she giv me ha numba. I comot my fone giv am.


As de babe wan stat de type ha numba naim I hear
4rm bak…..


” Mary mary ! Hot bebe…mary I don de find u since
o, wia u go “. Anita voice.


She and anita stat de yarn, she giv me bak my fone
say we go see anoda time, Folo anita enta field.



I look biggy dem, dia mind no even dey 4 wetin
hapun. I jus say mak I 4get dat 1.

6:30pm anita com bak. She buy 2 pop-corn, giv me
one pack. I warn am say I no like wetin she do 4
aftanoon. How she go jus kari pesin wey I de chat
wit comot like dat. She jus de laff, say na why she
buy me pop-corn mak she tak say sori.



Evriwia still dey lively, pple still de waka up and
down, comandant promise us say he go allow mak
we enjoy de carnival wella so na why evribodi
hapi….




Evribodi hapi but de cold jus much.


anita com de complain say she wan go hostel say d
cold don too much. I giv am my jacket but de tin no
stop ha cold. I com tell biggy say I de com mak I
escort am go ha hostel. We reach ha hostel, as we
enta inside omo I luk outside window see like 6
babes of differnt size and shape de baff outside.





De
security lite wey dey dia jus de shine 4 dia bodi,
som of dem get plenty hair 4 dia toto, som no get at
all, som get big brest, som get small, som get big
‘beer’ belle, som get flat belle. som get dia toto fat,
som get small toto…



“‘If dis girls catch u here no jus call my name o.
Abeg com de go ” anita warn me, by den my prick
don de raise head 4 my short ( I get luck say d
babes wey dey d hostel no notice say I enta. All of
dem jus de do dia tin. Na wen I reach door naim
one of dem raise alarm omo I jus run comot. I hear
as dem de laff.
As I still de go field naim she call me again 4 fone,
beg me mak I giv am my sweater say cold wan kill
am, i tell am say I no kari am comot 4rm hostel & I
no get strenght 2 trek go my hostel go bring am
now…
She say mak I comot in front of ha hostel mak she
escort me, I reply am say nobe pesin wey go escort
me be d mata, I no jus get strenght, I don tire…
“””Ok I go giv u mary fone numba”””. She reply me.
I laff 4 my mind, ask am weda she serious naim she
com swear. I tell am say I de com..
Anita promise say she go giv me mary numba but
wetin she leta giv me dat nite pass mary fone
numba, times 10

Previous Episode

Must Read: How I Take Service A

Next Episode

Must Read: How I Take Service A

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 9

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 8

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 7

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6
episode | 6 years ago

Must Read : Quality of love - Season 1 - Episode 6