Story of a Survivor - Season 1 - Episode 41

Episode 5 years ago

Story of a Survivor - Season 1 - Episode 41

Make I off the AC? I asked; yes Aunty, he said. I
switched off the AC and wound down the
windows.

How your People for House? I asked
Dem don go village for Holiday as usual, he said So instead make you dey hussle dey sell your water like before na igbo you sey smoke now? I asked

Aunty, I no dey smoke before o! na Nonso dem
force me to begin smoke o!

How? I asked

If I no gree smoke with dem, dem go chop my
food join their own, so dem say all of us must to go water side go smoke together, then we go come house come chop together, na so dem dey do me until the thing come master me, now if I no smoke igbo, I no go get appetite to chop food.

As you see me so na food I want run go buy
chop.

I remained calm for a while humming the music from my gospel CD, it helped.

What about your School I asked.

I don finish primary School last year, na
Mechanic work I dey learn now
You dey learn Mechanic work ? I asked; yes
aunty, na the thing we I de do now o!

You like the work? I asked; Aunty wetin I go do
nah? My Uncle say him no get money to send me go school.

What of Nonso dem? Dem dey learn work too? I asked;

No o! Nonso and Onyeka dey for Esut, Chidubem dey for I.M.T.

So all him Children dey go school, and only you
dey learn work?

Yes o! Aunty. He said.

You for like to go School too? I asked.

Yes nah Aunty! I pass my common entrance nah!

Dem give me admission for national Grammar
school Nlke, but my Uncle no gree make I go.

I maintained another two minutes silence by
humming the along with my gospel CD.

Your First School leaving certificate, dey your
hand? I asked;

No o! That one never ready; na my testimonial
dey my hand.

Chinedu! I called out; aunty he replied
You remember any of your Sisters at all so?

Yes nah! I no go fit forget Amara, na she senior me direct, he said

Na she use knife chook you for back abi?

Yes! He answered, suddenly his head jerked up as he looked at me with surprise: Aunty how you take sabi? He asked

Previous Episode

Story Of A Survivor - Season 1 - Episode 40

Next Episode

Story Of A Survivor - Season 1 - Episode 42

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)