The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 2

Episode 4 years ago

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 2

I continue watching my movie, though i will have to pay a fee for ignoring, me wey no get money were i wan see money pay, mtcheew abeg make them they go joor, i dey talk about Glory them they talk about environmental sanishtation, oh yeah Glory is her name, on the day of my birthday she was the first person to wish me happy birthday, because of that she called me by 11:30PM and we talk till 12AM, she say she nor want make another person first her wish me happy birthday, i like the girl sha, i love everything about her expecially her backside, and when she they ontop me they do kerewa oh men, my eye they turn me like person wey win lottery, that her yash na die, and also she they like dress cooperate, she’s a Science student so i understand, she’s short, dark and have fine face come get open teeth join am, and i believe say na that open teeth make her fine, no be me wey get two open teeth come make me be like Vampire 2.2, but i fine sha.
I watch movie till sleep enter my eye, around evening i stand up go check first bank for Aba/Owerri Road wether i go get small thing for hand, i reach there come see cue, i nor know why long cue they always they this bank upon all say them get many Atm matchine, so i decided to wait, yes i can do anything for Glory, na she be my glo unlimited.


I stay for line till twenty minutes, e be like the line no they move because na where i stand na im i still they, even some guys don fed up begin go house with anoyance, well them no get wetin them want use money do like me wey get party to host, i remain in the cue till night that means i spend one hour twenty minutes there, na one person come they my front and i begin smile for my mind small, devil wan come do im own as e dey reach my turn soldier come out from nowhere, as i see them na im i say make i quickly put my Atm card, the black man shouted “hey you hold am there” i pause immediately.

Soldier: you they see us wan come withdraw you wan quick put your Atm abi?

Me: sorry sir, i nor know.

Soldier: oya shift go one corner.

I shift oh, the others remain in the van while the oga stand for my front they withdraw, i nor want any wahala with those guys, they can be so wicked at times, i wonder where them they see their weed buy, the soldier wether na inspect him come inspect the Atm i nor know because him bend down begin they look every part of the Atm, him guys they motor they wait for am,

Soldier: na how this thing they work self?

Me: make i assist you?

Soldier: oya come.

Na Idiot na im be, him put card, and the Atm show
“Reset Password” or “put password”
so i press put password and told him him to put his pin.

Soldier: oya shift go back.

I give am space and i guess he knows the rest by himself, he withdraw money for good ten minutes, so when e reach my turn, i put my Atm and check my balance nothing they, “Oh My God” so i just spend good 2 hours here for nothing, no wahala there is god, there is god oh, i left the bank with anger, when i got home i took my phone and called my mum,


Mum: hello Oziegbe

Me: good evening ma.

Mum: how you they?

Me: i nor they fine.

Mum: hiah, abeg say you they fine.

Me: i nor they fine joor.

Mum: Oziegbe say you they fine now.

Me: okay i dey fine.

Mum: good, make you nor they use your mouth talk bad bad things.

Me: okay ma.

Mum: so wetin happen?

Me: we they go on excursion and i nor get money.

Mum: how much?

Me: five thousand naira.

Previous Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 1

Next Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 3

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)