The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 3

Episode 4 years ago

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 3

Basket Of Snails

Mum: so na because of five thousand naira you nor they fine ani?

Me: yes na everybody for class don pay finish na me remain.

Mum: then why you nor tell me since?

Me: na urgent oh.

Mum: how excursion go be urgent something abi person no go prepare down?

Me: them no quick tell us.

Mum: then you better wait oh because government never pay us.

Me: the dead line don pass oh.

Mum: tell them to hold on, abi them don pay una lecturer? i wonder wetin you they use all your money do.

Me: hiah, na handout na abeg mum try na.
Mum: no worry make month end you hear, bye bye.

She don cut am be that, so na wetin i go cum do now eh, i dey hate this kind nonsense joor, na now wey i need money na im fu-Ckup come they now abi, anyway make i see wetin my mumu neighbour go talk.


I leave my room go knock for my neigbhour door, the idiot loud music as if him they party, i wonder wetin him dey do for inside that room, i knock and knock and knock the idiot no hear, so i enter my room back and took my phone, i called him five times before he pick,

Joshua: na why you they disturb me na?

Me: my good neighnour, how you they?

Joshua: the one wey you they call me good neighbour so, make u know say i nor get garri for house oh, because i nor say everytime wey you need garri na im you they form good friend.

Me: hiah, come outside na i wan yan you something.

Josh: na better thing?

Me: yes na,. Na one babe like that wey i wan give you.

Josh: oya come my doormouth now.
I cut the call and quickly ran to his door, i saw him standing there.

Me: bros bros (i hail him)

Josh: forget that one joor, na which babe be that.

Me: na one oshere oh, the girl make sense die.

Josh: na how i go get her na?

Me: i get her number na.

Josh: oyaa call am for me sharp sharp.

Me: no wait first, e get wetin i need from you before i go give you the number.

Josh: na wetin be that na?

Me: i need you to borrow me five thousand naira month end i go give you back.

Josh: “chineke me ehh”,

Me: na why you they shout like that na?

Josh: you wicked well well, you nor like me at all.

Me: wetin i do you?

Josh: so because of only number na im you wan collect five thousand naira, god punish you.

Me: i go give you back month end na.

Josh: i dey tell you say no garri for house, you no get sense at all?

Me: abeg no vex bye bye idiot.

Josh: oyan anra.

Na mumu him just because of only five thousand naira na im they shout as if him they hospital wan born pikin, i nor know why that guy they always mumu like that oh.

I enter my room and close my door, time to sleep for tomorrow, school dey tomorrow and we get assignment self wey Mr. Joseph give us, and i hate calculus well well, i have to go school in time oh to copy from glory my lover, that girl head they scatter for calculus, wether them tear her head put test book i nor know, so i charge all my phone, torch and laptop, i took water out and baf, around after nine i snore into dreamworld,


::::::::


i see myself for big river with other fishermen, they took net and start catching fish, me i just stand they look them, they look like americans, i look my left and saw a basket, i took the basket and start packing snail on the ground, they many well well so i continue packing, as i was packing it i was couting them, i park twenty thousand snails, inside one small basket, then i took canoe and paddle it to one big stadium, i enter the stadium and start sharing it to evrybody, i make sure it get to everyone, then after i share the snail finish, i left the stadium and enter my canoe and paddle it back, on my way i saw a big ship with guns coming towards me, na those white guys wey i dey follow fish they the ship, as i saw them i try to get out of the way but they bend the ship to my side and wanted to crush me, as they wan just hit me na im i wakeup.
I look around and saw my alarm ringing, thank you alarm for saving me from that ship, but i wonder why my alarm they by 12:01AM, i dont rememebr setting my alarm oh.

Previous Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 2

Next Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 4

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)