The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 7

Episode 4 years ago

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 7

Mrs Faith

I begin they waka go Glory house (my sunshine) i love that girl so
much in that i can kill for her, you know what i mean? I nor mean kill
human being oh, i mean like catch rabbit and kill am for both of us.


As i dey go i dey see many many studunts for road, oh men, i don
fu-Ckup oh, i quickly put a call to Glory, she didnt pick at first, i
call her again they say number busy, the third time still number
busy, hmmm na wa oh, na which kind person she dey yarn with na wey
come make her number they busy busy, well i wait for five minutes
before i call her again, dont forget i dey road dey go her house oh, i
never even reach anywhere self,

Glory: hello.

Me: na wetin make ur number they busy na?

Glory: wetin happen?

Me: why you dey answer me like that?

Glory: tell me wetin you wan tell me, i dey busy they ready for school.

Me: abeg give me faith number i dey come your house make i nor miss
her for road.

Glory: she don commot tey tey self with the book,

Me: waoh, she go don reach school?

Glory: i dont think so, wait let me call her.
She cut the call, and me come stand for center of the street road they wait for her to call me back, make e
no be say i miss this gurl oh, after some minutes she called me again.

Glory: she say make you wait for her for catholic church wey dey our road,

Me: na there i even stand now.

Glory: okay keep on waiting i will soon join you guys.

Me: okay be fast, luv you.

Glory: love me? Abeg go sit down joor.

Me: na why you they talk like that na?

She cut the call again, na wa for this girl oh, na three times she don
cut my call today, three times abi two times? Well e be like say na
two times, but if we they argue i go say na three times.

I waka go front small and stand for front of the church begin wait for
miss Faith, faith na Glory roomate and i hate the girl with passion,
she too they form and me i nor they like people wey they form, anytime
i go visit Glory na so she go just form throway face commot for room
for us, even sometimes self Glory have to signal her before she will
leave or she will leave by herself when she see say we don start romance, i nor blame her, na becus of one mumu physics lecturer wey they
fu-Ck her black ass, she no even sabi anything apart
from english, her
score na yash she dey take get am, e get one time
wey she and one girl
they quarrel for school come see as them they insult each other,
shouting anyhow,


“”””””


me i dey paste result for board when faith come check her own, she
check am finish begin jubilate, e be like say she get A, then chioma
come check her own and her face change,
Chioma: hmm me wey i dey write everything, they answer question for
class, they score highest for test, how manage i come get BC? This
ojoro go stop oh.

She was so angry that she push faith out of the way, faith retaliate and
hold her back

Faith: are you okay or you are blind now because of your score?

Chioma: leave my shirt jare, see who they talk, as if you sabi anything.

Faith: i dont know anything but my scores are higher than yours.

Come see people don they comeout.

Chioma: your scores, is it what you wrote they give you, abeg commot
for my front jare, after you don go use your yash score point already
you come here they make mouth.

Faith: oh yes i score point with my ass go and die, na me say make you
get flat yash.

Chioma: i nor get your time joor.

Faith: nonsense girl like you wan form big girl for were i dey, you
fit go were i dey go


“”””””


“Oziegbe” i was shock that i came back to reality, i was so lost in my
thought that i didnt even hear my name been called.

Faith: did somebody die? (she came close to me)

Me: die as in?

Faith: because i’ve been calling since now.

Previous Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 6

Next Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 8

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)