The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 6

Episode 4 years ago

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 6

I waka reach school and those idiot security men tell me make i show
them my school ID card, i nor know when them bring this nonsense law oh, we nor
they show ID card before na, na to just enter gate, abi e be like say na the new rector bring
this yeye law,
me i nor hold my ID here,
and e be like say na me be first person for school apart from those
deeper life member wey them they sleep for school, or maybe them they
come around 5AM na them sabi, anyway i sit down for one restuarant wey
they there they wait for the first guy to show, i like the woman wey
they sell there for here well well, she get three children and one old man as
husband, wetin they trip me for the woman be say she get yash like
yatch, she get body come get big breast like toolz chai, women wey don born they
fine like this? some people they say once women don born them go lose
their shape, wether na true i nor know because e be like say na now
this woman shape they come out, omon na to find wey break the code oh, I hope them no go burst my head sha, to come imagine the tight tight clothes wey she dey wear self which guy head no go scatter?


I sit down for her frontage dey look gate like gateman, then i saw the
first guy, the guy dey ugly na once them go differentiate us, the guy
just show im id and enter inside, na wa oh, na why me nor come know na,
maybe na because i nor they like read notice board, na only when them
they paste result i dey near notice board, i remember when them put my
name for one of the guy wey win award (facebook award) na person come
tell me for class after three days, and i nor know say them put the
money for registration, na later when we dey collect clearance i know.

Three guys pass them nor fit my taste until i see one handsome dude
like me dey come, omon the way i rush get up as if i wan go toast am,
lol,

Me: bro how far na.

Bro: i dey oh, na wetin happen?

Me: u dey fear?

Bro: the one wey you just rush come so how I nor go fear na?

Me: guy no fear i just want ask something from you.

Bro: wetin be that?

Me: upon say you na guy like me, you gat to help, i forget my
school id for house and i need your own.

Bro: why you go forget your own?

Me: na rush oh.

Bro: if i give you my own na how i go come take enter?

Me: that one simple na, once you enter inside, you come back here and
throw your id for me, them me go use am enter.

Bro: how I go take know say u nor go run with am?

Me: come on bro wetin I wan use am do, na money e be? abeg help me joor.

Bro: hmmm, na how much you give me?

Me: bro abeg help me na, me i dey broke as you see me so.

Bro: then forget na if you nor go give me anything.

Me: you be guy man like me oh, why you wan fall fellow guy hand na.

Bro: no vex.

See this guy oh, him just waka leave me for there like i toast am him
no gree, oh men i go show that guy pepper,, imagine a whole senior
like me, and i believe say him go be my junior oh.

Waoh, if i say make i return back na, before i dey come back time don
go, so make i cucuma enter road they go Glory house, with luck i fit
see faith for road, so i carry my small bag and begin waka go Glory House

Previous Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 5

Next Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 7

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)