The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 10

Episode 4 years ago

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 10

The Money


Well i got to saint micheal and locate were they sell second hand laptop.

Make una come see as them they prize my fine laptop ten thousand, the
highest one na fifteen thousand naira, e just be like say make i slap
them, na which kind nonsense be this, laptop wey i buy fortyfive
thousand naira for second hand, wey nothing do am, and e dey work
sharp sharp, i just dont know what to do and i cant sell this laptop
for 15k is too small na, so i decided to giveup and go home,

i don they go house wey i beging they think the implication of wetin i
dey do, if i dont make this birthday a day to remember for glory i nor
go ever dey happy with myself, come imagine wetin she go they think,
she go vex for me wella, she fit even breakup with me because this one
na her first birthday wey i dey witness, and she don they use this
birthday they sing for my ear since we enter this relationship, she
say she nor dey celebrate her birthday before and she hate it, but i
manage persuade her to let me celebrate it for her, so since then she
has be reminding me everyweek to make sure that her first birthday
celebrate will be a tale to remember forever, well no bi my fault na,
no money oh, money wey i be they gather for her na im i use play
bet9ja wey gunners go fall my hand, omo i nearly get hypertension that day, if
no be glory wey console me na only God know where I for they now.

I was going home when i suddenly stop at once, i remember wetin she
tell me before say when she dey five and her parents wan celebrate her
birthday na that time her elder brother die because of her through
accident, because he dont want to miss the celebration, when i
remember i turn and make up my mind to sell the laptop for fifteen
thousand naira, so i return back to the shop and meet the mumu boy.

Guy: you don ready to sell am now.

Me: yes but add something oh.

Guy: i nor even get that fifteen thousand naira again self, na ten
thousand naira dey here.


Me: so wetin you mean.

Guy: take ten thousand or you dey go.
Hmmm na which kind trouble be this na, and na only him be say fifteen
thousand oh, so na wetin i go do nam i gat no choice than to sell the
laptop for that amount.


Me: oya bring the money.

Guy: correct guy na now you come.
Why him no go happy wey i dey sell laptop of 90 thousand naira to am,
na idiot im be, even though the laptop they work fine fine, nothing do
am, the thing they pepper me for body i swear, so he sat down and look
at the laptop, he open it and check if the laptop is okay, when he see
that there is no fault, he shake him head like mumu and smile, hh
give me make i hold am and enter inside go bring money.

Then message enter my phone, i be no wan look am but i just say make i
read am say e fit be faith, so i read it and what i saw shock me.

Twenty thousand naira was transfered to my unity bank account, i look
at the name i dont know this person oh, but who cares, i left guy shop
and ran home jubilating.

Previous Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 9

Next Episode

The Mysterious Twenty Thousand Naira - Season 1 - Episode 11

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)