Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 12

Episode 6 years ago

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 12

"Guy Ola na our man ooh, make we no just leave am like that, him fit die there ooh" Like he was not already dead.

"Guy na one slap dem slap Ola nahim him die ooh" Nnamdi had always wanted Ola dead.

"Him never die, him go come back house" Ogbonta assured, "but my land! My land no go come back, Ali ndam!"

"Guy but you sure say na Dornu do you this thing?" Nnamdi said as they drove pass the Obiri Ikwerre bridge heading to Rumuigbo.

"Yes na! I dey sure! My guy wey dey stay close to that my land tell me say him see her when she dey sell the land to one big man"

"Women are wicked ooh! That girl? But her papa rich na, wetin she wan do with the money wey she get as she sell your land, wetin?"

"Mehn i no know oh, abi she wan just wicked me"

Silent for a while Nnamdi said, "But guy ooh i get one plan ooh, i no know whether you go like am ooh"

"Wetin be the plan..............?"




Meanwhile, purewater was poured on Ola to regain consciousness and stop his Epilepsis.

"Who you be?" One of the soldiers asked recovering Ola.

"Me? I be, i beeee........ I beeeeeee..."

"You be who?" Another of the soldiers yelled.

"I be Daughter of Zion" Ola murmured.

"You be wetin??" Another soldier yelled.

"I be Daughter of God" One slap and Ola was instantly transgendered.

"Daughter of God! Na your name be that?"

"Yes! Na my name" Ola had left planet earth.

"Okay, Daughter of God wetin bring you here?"

"God! Na God bring me here"

"God? Who be God?" A nonesense question.

"God na! God of Rumuigbo na, you no know am?" Ola was "jelly-fishing"

After about 30 minutes of asking stupid questions and getting f'oolish answers. "Abeg leave this m'umu make him dey go, spit don dey comot for him mouth, na die him dey so oooh!" One of the soldier suggested.

One of the soldiers - the slapping minister dragged Ola up yelling, "My friend if i see you near this place again i go change your name from Daughter of God to Woman of God"

"Yes ma! Yes ma! Yes ma!" Ola repeated.

Our Ola had turned genderology (if there is a word like that) converting everything male to female.

"Oya dey go!" Slapping minister pushed Ola.

"God! I no dey see well again, i don blind, my n'yash dey hot, catar dey catch me, i won piss, s'hit dey catch me, my body dey hot, my belle dey turn, my body dey shake, e be like say i get high blood pressure, yeeeh! Where road?" Ola creep-walked to the bus-stop.

"Olaniyi na man you be! Be strong!" He encouraged himself

Standing at the bus stop Ola was floating and bubbling, his phone rang.

"What is calling me?" Ola now a Living-to-nonliving-thing-ology.

"Whatin be this?" He asked his phone.

He managed to pick the call, "Hello! What am i talking to?............................. Ade na you?" Ade's voice on phone strengthened Ola.

".......................... You say wetin? The game wey i play enter..........Ehhn, You sure?.............. So i don chop 50k!" Ola's eyes cleared instantly, he was healed, the good news healed him.

"I don chop 50k ooooh!" He shouted.

Previous Episode

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 11

Next Episode

Must Read: " Na Man You Be " - A Story By Flow1759 - Season 1 - Episode 13

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)